But make di ponishment fall for Joab and en family head! For evry generashon, make one man from en family sofa sickness like leprosy; bad skin diziz; dey waka with walkin stik, make e die for war or nor si food chop!”
God go ponish Joab for doz pipol wey e kill, wey David my papa nor know about. Joab kill two innocent men wey betta pass am: Abner wey bi Israel soja kommander and Amasa wey dey kommand Judah sojas.
Dis na di decision wey di angel make. So, make evribody wey dey di world know sey di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E choose! Even to di pipol wey small pass!’
Dem go drive yu komot from where human being dey stay and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu and yu go sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.
But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi. I praiz di Most High God kon give honor and glory to di Pesin wey dey live forever and en kingdom go last forever.