15 E dey dig deep pit for odas, but na en ensef dey fall enter
So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.
Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”
But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am.
Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.
Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol. So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.
Doz wiked pipol wey hate yor laws don dig pit to katch mi.
Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap and free mi from dia trobol.
My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.
Yu dey free dem from trobol and dem go dig pit wey go katch dia enemies.
So, anybody wey dig pit for pesin go fall inside my ensef and pesin wey roll stone to wound odas, na di stone go fall kill-am.
Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
Una just dey make yeye plans and evritin wey una dey do, dey yuzles. Di air wey una dey breath, na fire wey go distroy una.
Una dey go kourt and dey lie for each oda head. Una dey put hope for lie, so dat una go win una kase. Una dey make plans to take hurt oda pipol.
Na evil dem dey take pay good? Naw, dem don dig pit for mi make I fall inside. Wen Yu dey vex dat time, make Yu remember as I beg Yu bikos of dem, so dat Yu nor go ponish dem.
King Darius kom rite give all di pipol, nashon and language wey dey di land sey: “I greet una!