14 Pesin wey karry wikedness and bad plans for belle, dey born lie-lie.
Wiked pipol go sofa ponishment as long as dem dey dis eart. Na pains go full dia years for dis world.
Dis na di pipol wey plan trobol and born wikedness. Na lie full dia belle.”
Una just dey make yeye plans and evritin wey una dey do, dey yuzles. Di air wey una dey breath, na fire wey go distroy una.
I go inkrease dia wahala, I go use all my arrow for dia body.
Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.