For dat day, God go use en great and pawaful swod take ponish and distroy Leviatan; dat dragon wey dey twist and waka fast-fast. Yes! God go kill di great monsta wey dey inside sea.
“Naw, mi wey bi God wey get pawa dey tell Israel pipol sey I go judge evribody akordin to wetin e do. So make una turn from sin and all di bad tins wey una dey do, so dat una sins nor go distroy una.
Jerusalem pipol nor go bilive wetin dey happen, bikos of di agriment wey dem make. But na to make dem remember dia sins and to warn dem sey dem go katch dem go prison.”
Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’