Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 7:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Na God bi my guide! E dey save doz wey get klean and true heart.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 7:10
15 Iomraidhean Croise  

Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”


Den e tell Solomon, “My pikin, I kommand yu sey make yu know yor papa God and make yu use all yor mind and heart take serve am. E know all wetin wi dey tink and wetin wi wont. If yu go meet am, E go take yu, but if yu turn from am, E go abandon yu forever.


make Yu listin to dem from heaven; forgive dia sin kon ansa each pesin akordin to wetin Yu tink sey dey en mind. (True-true, na only Yu fit really know wetin pesin dey tink.)


if yu klean yorsef kon koll am yor Savior, E go help yu kon give yu back evritin.


En shidren-shidren go get pawa for dis world and God go bless di pipol wey dey obey am.


My God, make Yu do good to pipol wey dey good; doz wey dia heart and mind dey with Yu,


But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.


Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.


Yes! Awa proteshon dey kom from God and na en wey bi di Holy One for Israel, bi awa king.


God hate pipol wey get bad mind, but E love doz wey dey do di rite tin.


Raitious pipol and doz wey get respet go stay for di land wey bi awa own.


Dey always tok trut and e go save yu, but if yu dey play wayo, na wons yu go fall.


So I pray to God: “My Oga God wey dey rule all of us; yor judgement na true and Yu dey si wetin pipol dey tink for dia heart. Make Yu fight dis pipol for mi, bikos my life dey yor hand.”


Na mi wey bi God dey si and test human being heart. I dey trit each pesin akordin to how e dey live en life and wetin e dey do.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan