9 True-true, di love wey I get for yor house dey shark mi; so I dey bear di curse wey dem dey curse mi.
E ansa, “My Oga God wey get pawa, na only Yu I dey serve, but Israel pipol don break di kovenant wey dem make with Yu. Dem skata yor altar kon kill all yor profets. Na only mi remain and dem won kill mi too!”
Even with all dis tins wey I don gada, I still give my silva and gold, bikos of di love wey I get for God Temple.
“God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi.
E dey pain mi well-well wen my enemies nor gri listin to yor laws.
Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.
Anybody wey dey pass, dey tif from am and en neighbours don take am dey do yeye.
Even Christ nor do tins wey go just make ensef happy, but just as dem rite for God word, “Di pesin wey curse yu, don curse mi.”