Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 69:36 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

36 En savant shidren-shidren go inherit am and pipol wey dey loyal to am go stay der.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 69:36
13 Iomraidhean Croise  

Yor savant shidren-shidren go always dey save. Dia shidren-shidren go always dey save for yor present.”


Doz wey dey fear God go inherit di land and dem go stay der forever.


God sey, “I go save pipol wey love mi. I go protet doz wey trust my name.


But wen my savant tok wetin go happen; wen I send my messenjas go tell una wetin I plan, I dey make doz plans, happen. I tell Jerusalem sey pipol go stay for der again and dem go ribuild Judah town. Even doh dem skata am before, I go raiz am up again.


Dem go know dem for all di nashons and anybody wey si dem, go know sey dis na pipol wey I bless.”


Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.


Bikos dis promise na for una, all una pikin, pipol wey dey far place and all di pipol wey God go draw near ensef.”


And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.


Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.


My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?


But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan