3 I don taya to dey shaut for help; sore dey my trot naw and my eye don taya to dey look for my God.
But wiked pipol eye go blind and dem nor go si where run go. Di only hope wey dem get, na make deat kom karry dem go.”
I kry sotey my eyes don dey red and swell-up and naw, na only darkness I dey si.
I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi; so dat evritin go bi just as Yu promise mi.
My eye just dey look to si sey wetin Yu promise, dey happen. So wen Yu go kom help mi?
My strent don dry like mold wey sun beat. My tongue don gum my mout. Yu don trow mi for groun kon leave mi make I die for der.
My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa. Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
So, my God, where I won put my hope? Na Yu bi my only hope.
E don give mi new song to sing and hymns wey I go take praiz awa Oga God. Many pipol go si wetin E do kon praiz am, den dem go start to trust God.
I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes.
Dem dey put poizin for my food kon give mi bad wine make I drink.
Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi.
I nor fit shaut and I dey weak kon dey do like dove. My eyes don taya to dey look heaven. So God, make Yu save mi from all dis trobol.
I don kry sotey wota nor gri kom out from my eye again; my heart don break. I don taya and e dey pain bi wen I si how dem distroy my pipol and how shidren dey faint anyhow for di town.
Wen Jesus si sey evritin don finish, e kon sey, “Wota dey hongry mi”, (dis show sey wetin God tok, really happen).
God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin.
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.