Dem don opress mi and I nor get anytin! Abeg my God, make Yu kwik kom save mi, bikos na Yu bi my helpa and di Pesin wey dey diliver mi! So make Yu kwik kom!
Na Yu bi di hope wey Israel get; so make Yu disgrace doz wey leave Yu. Make dem disappear like name wey dem rite for san, bikos dem forget Yu wey bi di spring wey dey bring fresh wota.”