Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 69:26 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

26 bikos dem don curse di pesin wey bi yor own. Wen Yu ponish pipol wey bi yor own, na dis wiked pipol dey karry di matter go evriwhere.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 69:26
10 Iomraidhean Croise  

Oded wey bi God profet, dey der. E go meet di sojas wen dem rish Samaria kon sey, “Si, bikos una grand-grand papa God dey vex with Judah pipol, na-im make am give dem to una. Una don kill dem well-well and God know evritin.


Dem follow mi as I dey run kon dey try to distroy mi and e nor get who fit stop dem.


Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.


Na God wont make e sofa and en deat na sakrifice, so dat God go forgive pipol dia sins. So en days go long and e go si en shidren-shidren and thru am, God go do wetin E wont.


But E bear di sofa and pain wey suppose bi awa own. But wi tink sey en sofa na di ponishment wey God gi-am.


but I dey vex for di nashons wey feel sey dem dey save. Bikos as I dey try make I nor vex for my pipol, doz nashons dey make my pipol sofa more-more.


God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol


Di same Jew pipol wey dey ponish us, na dem still kill awa Oga God Jesus Christ and di profets. Dem dey wiked to evribody and nor dey do wetin God wont.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan