Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 69:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Doz wey dey sidan for di town gate dey tok about mi and pipol wey don drink, dey sing and laf mi with dia song.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 69:12
15 Iomraidhean Croise  

Di two angels kon rish Sodom for evening and dat time, Lot sidan for di town gate. Wen Lot si dem, e get up go meet dem kon bow face groun.


Wen dem dey sick, I dey sorry for dem. I dey ponish mysef as I dey fast for dem. If I dey lie, make God nor ansa my prayers!


My God, Yu don deceive mi! Yu don deceive mi so dat I go bi yor profet? Yu strong pass mi and Yu get pawa well-well. Naw, evribody dey look and laf mi.


Instead, yu dey against God wey get heaven and eart. Yu bring all di tins from di temple, den yu and yor men, plus yor wife and yor girl-friends kon use dem dey drink wine. Yu dey praiz di gods wey dem make with gold, silva, bronze, iron, wood and stone; gods wey nor even fit si, hear or undastand! But yu neva ever praiz God wey dey kontrol yor life and ways!


But di priest oga dem and di eldas sey make di pipol ask for Barabas, so dat dem go fit kill Jesus Christ.


dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”


For all di towns wey di Oga una God dey give una, make una pick doz wey fit judge from each tribe for Israel. Di judge dem must judge di pipol well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan