34 Make una tok about di pawa wey God get; en mighty pawa wey dey save Israel and di pawa wey E show from di sky!
Make wi Praiz God! Make wi praiz am for en temple; make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!
God vois get pawa well-well; en vois get glory.
Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa.
Na di God wey go dey forever bi una guide and provida. En hand wey go dey forever, dey support una. E drive all una enemies kon sey make una distroy dem!
God gi-am honor and glory wen di vois sey, “Dis na my Pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”
Den I hear many pipol vois wey bi like river and tonda nois dey shaut: “Halleluya! Na awa Oga God wey get all pawa dey rule!