24 My God, dem dey si as Yu take dey waka; true-true, my King wey dey mash kom with glory, pipol dey si as E dey kom.
David with all di pipol kon dey dance with dia heart to honor God. Dem sing dey play instrument, harp, drums, cymbals and trumpets.
Den for di end, evribody go sey, “Yes! Pipol wey dey obey God, go get dia reward. True-true, wi get God wey go judge di whole world!”
I don si Yu for di temple kon si yor mighty pawa and glory.