Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 68:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 bikos Yu dey stay with dem. My God, na yor blessing save doz wey dem dey opress.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 68:10
18 Iomraidhean Croise  

make Yu listin and ansa dem from heaven. Make Yu forgive di king and Israel pipol for dia sins kon tish dem di rite way. Den, my Oga God, make Yu send rain kom dis land wey Yu give yor pipol as dia own forever.


Yu dey wet di dry groun with rain, so dat di soil go soft and seeds go grow well.


Yu crown di year with yor good blessing and even where hard pass, still dey produce plenty food.


Yu visit di eart kon make rain fall put, so dat e go dey good kon produce plenty food. Yu make wota full di sea and di land dey bring betta food, bikos Yu don kommand sey na so e go bi.


Make Yu nor let dis wiked animal distroy yor pipol. Yor pipol wey dey sofa, make Yu nor forget dem forever.


Yes! E fit nak rock make wota kom out, but E nor fit give en pipol bread and meat.”


E dey give strent and pawa to pipol wey dey weak.


Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”


Blind pipol dey si, pipol wey nor fit waka dey waka, God dey cure leper, deaf pipol dey hear, pipol wey don die, dey wake-up and poor pipol dey hear di Good News.


E don make doz wey dey hongry beleful with good food and pipol wey get money well-well, E don make dem poor.


Den una go sey, “Awa papa Jakob waka from Aramean go stay for Egypt as strenja. En family for dat time, nor many, but wen dem dey komot Egypt, dem kon plenty and dem bi strong pipol naw.


And make una nor dey opress God pipol wey dey under una, instead make una bi ezample to dem.


E dey karry weak pipol komot from san-san and dey make poor pipol sidan with prince and princess kon put dem for where pipol go honor dem. Di foundashon wey di eart sidan put, na God get am; na on-top am E build di world.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan