E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”
But wen di seven years don pass, mi, Nebukadnezzar kon look heaven and my sense kom back to mi. I praiz di Most High God kon give honor and glory to di Pesin wey dey live forever and en kingdom go last forever.
Yu nor fit kompare God with anybody for dis world. E dey do wetin E like with di angels for heaven and pipol for dis world. Nobody fit shalenge or ask am, “Wetin Yu tink sey Yu dey do?”