Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 66:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 I go enter yor temple with sakrifice; I go do di tins wey I promise Yu;

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 66:13
19 Iomraidhean Croise  

Wen yu pray, E go ansa yu and yu go keep di promise wey yu don make.


So make una sing tanksgivin song as una dey enter en present! Make una enter en temple with tanksgivin. Make una tank and praiz en name.


I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.


Di gate wey raitious pipol dey pass enter, make Yu open am for mi, so dat I go-go inside go tank God.


Di Oga na God, so make wi start di celebrashon with sakrifice, as wi dey mash round di altar with bambo leaf for awa hand.


I go praiz Yu for where yor pipol gada. Doz wey dey woship Yu, na for dia present I go for do wetin I vow.


My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.


Bikos Yu hear and ansa awa prayers; so evribody go kom meet Yu.


Wen yu promise God sometin, make yu do am kwik-kwik, bikos E nor get anytin to do with fools. So make yu do wetin yu promise.


But as for mi, I go sing praiz Yu; I go offa sakrifice give Yu kon do wetin I promise, bikos na only Yu fit save mi!”


Si! One messenja dey from di mountin kom give una good news! E dey bring peace message kom. So my pipol for Judah, make una celebrate kon do wetin una promise, bikos una wiked enemies nor go ever enter una land again and God go distroy dem finish.


But e nor go bi sin, if pesin nor make promise or vow at-all.


Anytin wey una promise, una must dey kareful sey una do am. And di promise wey una make to di Oga una God must kom from una free mind.


If una enter una neighbour vineyard, una fit chop as many grapes as una wont, but make una nor take any one komot from di vineyard.


True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”


Wen e si am, e vex kon tear en klot. E kry kon shaut, “Oh my dota! Yu don distroy mi! Yu don kause wahala for mi! I don make vow give God and I nor go fit take am back.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan