1 Make di whole eart shaut with joy as dem dey praiz God!
So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.
Make evritin wey dey dis eart, shaut with joy to God!
Make evritin wey dey alive, sing praiz God. Make evribody praiz God!
bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.
Make wi sing praiz God wey bi awa strent. Make wi sing praiz Jakob God.
Make una sing new song for God! Make di whole world sing to am!
So make all di eart shaut to God; make all of dem bigin praiz and sing for joy!
Pipol go dey sing for evriwhere for di world as dem dey praiz Israel pipol God wey dey raitious. But I nor get hope at-all and na die I dey die go so, bikos pipol wey dey lie, still dey lie and doz wey dey deceive odas, still dey deceive!