Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 65:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 But blessing go follow di pesin wey Yu choose to stay yor palis. Make di good tins wey dey yor house, yor holy place, beleful us.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 65:4
22 Iomraidhean Croise  

den make Yu listin to dia prayer for help from where Yu dey stay for heaven. Make Yu sorry for dem; help and forgive yor pipol for all di sins wey dem kommit.


True-true, God don choose Jakob as en own and Israel pipol as en own pipol.


My God, na who go fit woship for yor temple? Na who go enter yor present for yor holy hill?


Bikos I dey raitious, I go si Yu. Wen I don leave dis world kom meet Yu, I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.


True-true, en goodness and love wey nor dey fail go dey follow mi till I die and I go dey for God house forever and ever.


Naw, evry old gate, make una open! Evry old door, make una open, so dat di King wey get glory go enter inside.


Si as blessing full di nashon wey God bi dia God, bikos God don take dem as en own.


Yu dey feed dem from di plenty food wey Yu get for yor own house kon let dem drink from yor wota wey dey give life,


Bikos of my sins, di sore for my body don start to smell.


Make una know sey, God dey keep doz wey dey fear am for ensef and E go ansa wen wi koll am.


Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu


Pipol wey dey stay and always praiz God for en temple, make una si as dia blessing big rish!


Doz wey don taya, I go give dem wota drink kon feed doz wey don weak bikos of honga.


E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.


Before God kreate di world, E choose us thru Christ bikos E love us, so dat for en front, wi nor go get any fault and wi go dey holy.


But my brodas and sistas wey God love, wi dey always tank God for una evritime, bikos God don choose una from di biginnin sey, E go save una with di Holy Spirit pawa wey go make una dey holy, since una get faith and trut.


Anybody wey fit bear rish di end, I go make am pila for my Papa Temple and e nor go ever komot from der. I go rite my Papa name; David Town; di new Jerusalem wey dey kom from heaven and my own new name, put for en body.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan