wen God take mi komot from my papa house and I kon tell Sarah sey, ‘Anywhere wi go, di only tin wey yu go do to show sey yu love mi, na to tell dem sey I bi yor broda.’ ”
God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”
So, I beg make yu kom help mi curse dis nashon, bikos dem too get pawa pass mi. May bi I go defeat and drive dem komot from di land. Bikos I know sey anybody wey yu bless, blessing go follow am and anybody wey yu curse, curse go follow am.”
“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey travel go evriwhere just to win one pesin kon meet God and afta una don win am, una go kon make am bad well-well like devil pikin, pass as una bi!