5 Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.
E go bless di pipol wey dey obey am; both small and big.
Make Yu protet mi as pesin dey protet en own eye. Make Yu hide mi under yor feada.
My God, I go do wetin I vow to give Yu and tank Yu, bikos of how Yu dey help mi.
My God wey dey Zion, na betta praiz dey wait Yu, bikos yor pipol dey do wetin dem promise.
But God dey hear and listin to my prayers.
so make Yu tish mi yor ways, so dat I go live my life as Yu wont am! Make Yu give mi pure heart, so dat I go always dey honor Yu.
So dis na wetin I tok about God: “Na only en bi di place where I dey hide put, where wiked pipol nor go for fit tosh mi; na-im bi my God and I trust am well-well.”
but for evry tribe, di pesin wey fear am and dey do wetin good, na dat pesin, E dey like.