3 True-true, na Yu dey save mi; my strong towa wey dey protet mi from my enemies.
E dey listin to mi, so as long as I dey alive, I go dey pray to am to help mi,
My God wey get pawa, di strong One wey save mi, na Yu protet mi wen my enemies dey fight mi.
Na God bi di rock wey dey protet mi. Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi and I dey save inside am.
Bikos E go must guide mi wen trobol kom kon hide mi for en temple. E go put mi on-top one high rock where nobody go fit tosh mi.
My viktory and honor dey kom from God. Na-im dey guide mi and na-im bi my Rock, so nobody fit kom attack mi for der.
God name na strong place to hide put, raitious pipol dey run enter and dem dey-dey save.
E save us from deat and E go diliver us. Wi don put awa hope for en hand sey E go diliver us again.