Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 60:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 60:7
9 Iomraidhean Croise  

Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


Some from Manasseh tribe still go meet David wen e follow Filistia pipol go fight Saul. (But, e nor help di Filistia pipol, bikos dia king dey fear sey e go sell dem give Saul wey bi en oga before, so dem send David and en men go back to Ziklag.)


Doz wey kom from di oda side for Jordan River: From Reuben, Gad, and di half tribe for Manasseh: na 120,000 sojas wey karry difren weapon.


As God holy rish, E kon promise sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley.


Josef get bull strent and wiked melu horn. E go rule pipol kon porshu dem rish di end for di eart. Dis na my blessing for Efraim and Manasseh pipol.”


Di land wey dem give half of Makir shidren wey Manasseh bi dia grand-grand papa na: half for Gilead land, Ashtarot and Edrei and King Og for Bashan kingdom and na akordin to dia family.


Josef first-born, Manasseh, dem give en tribe some land too. Manasseh first-born Makir wey bi Gilead papa, dem gi-am land, bikos dem bi wariors. Dem give dem Gilead and Bashan.


David ansa, “If na so di kase bi, den yu go know wetin yor savant fit do!” Akish kon sey, “Den I go make yu my bodyguard from naw go.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan