Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 60:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 God don tok from en holy place sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 60:6
21 Iomraidhean Croise  

Abram travel pass Moreh oak tree for Shekem. (For dat time, Kanaan pipol dey stay for di land.)


Naw, una shance don kom. Make una remember sey God sey, ‘I go use David my savant take save Israel my pipol, from Filistia pipol and all dia oda enemies.’ ”


Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word.


God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.


I praiz God for wetin E don promise. I trust God, so wetin go make mi dey fear?


Before-before, Yu tok thru vishon to pipol wey dey obey Yu. Yu sey, “I don choose sojas and I don selet one yong man from di pipol as king.


Yes! I don promise David and bikos I dey holy, I nor go fit lie:


Dis na wetin God tok about lie-lie profets: “Dem don break my heart and all my body dey shake. I bi like pesin wey don drink wine well-well, bikos of di wey dem dey trit mi and my holy word.


Bikos God dey holy, E don promise sey, “Di day dey kom wen dem go karry all of una go for inside basket like fish wey hook katch.


“Make yu dey strong and get heart! Yu go lead dis pipol go win di land wey I don promise dia grand-grand papa sey, I go give dem.


Bet-Haram valley still dey join, plus Bet-Nimrah, Sukkot and Zafon go rish di rest side for Heshbon wey King Sihon dey rule; plus di aria for Jordan River east go rish di end for Kinneret Sea.


Manasseh borda na from Asher go Mikmetat wey dey near Shekem. From der, e from sout face doz wey dey stay Tappuah.


So dem selet Kedesh for Galilee wey dey Naftali kountry on-top di hill; Shekem wey dey Efraim kountry on-top di hill and Kiriat-Arba (wey bi Hebron) wey dey Judah kountry for hill.


Joshua gada Israel pipol for Shekem. E koll Israel leaders, rulers, judge and all of dem kom God present.


Josef bone wey dem karry kom from Egypt, Israel pipol kon beri am for Shekem, for part of di field wey Jakob buy from Hamor sons (Na Hamor bi Shekem papa) and Jakob buy di field for one hundred silva koin.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan