Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
God still tell Moses, “Yu must tell Israel pipol sey, ‘God wey bi una grand-grand papa God; di Pesin wey bi Abraham, Isaak and Jakob God, na-im send mi kom meet una.’ Dis na my name forever and dis na wetin pipol go take remember mi from one generashon go rish anoda.
Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.
But my God, Yu know all dia plan to kill mi. Nor forget di wiked tins wey dem dey do and nor forgive dia sin. Make dem die for yor front and make Yu ponish dem as Yu dey vex.”
All of us wey dey rule yor kingdom, doz wey dey wosh wetin wi dey do; di kounselor, wise men and all di oda royal men, don gri sey make yu give orda kon back am with pawa sey, ‘For thirty days, anybody wey pray to any god or human being wey nor bi yu, make dem trow am for lions pit.’
God sey, “Israel pipol, una dey important to mi pass Ethiopia pipol? Just as I bring Filistia pipol kom out from Krete and Siria pipol kom from Kir, na so too, I bring una kom out from Egypt.