2 Save mi from pipol wey dey do bad tins and doz wey like wahala well-well.
My God, I wish sey Yu go just kill wiked pipol finish! So make wiked pipol leave mi alone o-o!
Make Yu nor let mi sofa with my enemies and nor kill mi with wiked pipol.
Wen wiked pipol and my enemies won kom attack and kill mi, dem dey stagga fall.
But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.
If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion and nobody go fit save mi.
Naw, who go protet mi from wiked pipol? Who go help mi fight doz wey dey do evil?