3 and E go send help kom from heaven kon save mi, den disgrace doz wey won kill mi. My God go send en goodness and love wey nor dey fail kom.
My savants neva ever sey, ‘Awa oga let hunga kill some pipol.’
God go fight for mi. My Oga God, yor love wey nor dey fail, go dey forever, so make Yu nor rijet di pipol wey Yu kreate by yorsef.
So Oga God, make Yu nor stop to dey sorry for mi. Make yor love and faith wey nor dey fail, always dey protet mi.
Make Yu send yor lite and trut kon guide mi. Make dem karry mi go yor holy mountin, di place wey Yu dey stay.
Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.
My God! Na Yu make us dey save and dey prosper and even evritin wey wi get, na Yu give us.
Israel pipol go bi like strong lion wey nor dey rest until e don distroy en enemies kon drink di blood of di pesin wey e kill.”
Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.
Wen Pita si sey all dis tins wey dey happen nor bi dream, e kon sey, “Naw I know sey, True-true, God send en angel kon save mi from Herod hand and from all di tins wey di Jew pipol tink sey go happen.”