3 Bikos strenjas dey attack mi; wiked pipol dey try to kill mi and dem nor kare about God.
I don make God nomba one for evritin wey I dey do and bikos E dey for my rite side, I nor go shake or fear anytin.
Make E kom help yu from en temple, den give yu pawa from Jerusalem.
My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi. Dem don shuk my hand and leg.
Wiked pipol nor get good heart and dem nor dey fear God.
Make shame and disgrace follow di pipol wey dey try to distroy mi. Pipol wey dey happy bikos I dey sofa, make disgrace follow dem.
My God, make Yu show sey I dey innocent! Save mi from pipol wey nor dey fear Yu. Diliver mi from doz wey dey lie,
Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God.
My own brodas dey trit mi like strenja; dem dey do like sey I kom from anoda kountry.
My God, wiked pipol dey raiz against mi; sturbon pipol dey won kill mi. Yu nor mean anytin to dem!
Dem go do all dis tins, bikos dem nor know mi and my Papa.