E distroy en temple like sey na vineyard kon skata where wi for dey woship am. God make Zion pipol forget dia festival and Sabat Day. Naw, kings and priests don fall, bikos E dey vex.
I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.
“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.