7 “Si wetin happen to dis man wey nor trust God and tink sey e strong. E trust en money kon dey happy for di wiked tins wey e dey do.”
But just as dem dey rut plant komot for groun, na so God too go porshu wiked pipol kon rut sinnas komot from di land.
Wi nor fit kontrol breeze or tok di day wen wi go die. Dat na one war wey wi nor fit run from and wikedness nor go fit save doz wey dey do evil.
God sey, “I go curse di pipol wey leave mi kon go trust human being. Pipol wey depend on flesh and blood for dia pawa.
So Jesus kom outside, with di shuku-shuku crown for en head and di fine klot wey dem gi-am wear. Den Pilate kon sey, “Na di man bi dis!”
Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.
Sisera fall kon knee down for di woman front. Na di woman leg e fall near and na der e for die