Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 51:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So make Yu klean mi from my sins and I go dey klean; make Yu wosh mi and I go white pass snow.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 51:7
14 Iomraidhean Croise  

No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being.


Dia spit bi like wiked snake own; dem bi like kobra wey nor dey hear word;


Make una deep di plant wey dem dey koll hyssop inside di blood, den take di blood rub di two pole for di door and di one wey cross dem for up. And make anybody nor komot from inside en house until morning.


Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.


So Simon Pita tell am, “Oga God, make yu nor wosh only my leg, but make yu wosh my hand and head too!”


Wen Moses read all di kommand give Israel pipol, e take goat and ram blood with wota and soap, kon sprinkol di blood on-top di Law Book and all di pipol body, den e sey,


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan