“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.
and from Jesus Christ, di witness wey dey tok trut; di first-born among doz wey God raiz from deat and naim bi di King of all kings. Christ wey love and free us from awa sins with en own blood;
I kon ansa, “My oga, na yu know di ansa.” Den e sey, “Dis pipol die bikos of Christ. Dem don use di Lamb blood take wosh dia klot, naim make am white like dat!