If anybody tank God with dis ofrin, e go still bring bread wey dem nor make with yist: weda di bread strong or dem mix am with olive oil. E fit bi biscuit wey dem rub olive oil put or kake wey dem make with flower kon mix am with olive oil.
My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.