3 Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning, I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.
Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help.
I dey wake-up before day break well and yor words dey give mi hope.
My Oga God, make Yu listin and hear mi as I dey kry for mesi!
Di way I dey find God, sirious pass as gateman dey wait make day break. Yes o-o, e sirious pass as gateman dey do for morning.
I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.
My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa. Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
Na yor pawa wi go take porshu awa enemies; na yor name wi dey take mash dem for groun.
For morning, aftanoon and nite, I dey kry with pain and God hear my vois.
My God, make Yu ansa mi, bikos yor love wey nor dey fail, dey good and bikos of how Yu dey sorry for pipol, make Yu turn face mi!
But Yu God don bi my King since my grand-grand papa dem time and Yu dey save us for dis world.
Pipol wey dey stay and always praiz God for en temple, make una si as dia blessing big rish!
My God, I dey kry give Yu and I go kontinue to beg Yu evriday by day.
I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.
Yu hear my kry for help wen I sey: ‘God make Yu listin to mi well-well!’
For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.