7 Yet dem nor fit save demsef from deat or pay God for dia life:
E kon dey boast give dem sey e get money well-well; many sons; how di king don promote am and how e dey important to di king pass any oda offisa.
Rish pipol dey tink sey di propaty wey dem get go protet dem like strong high wall wey dey round di town.
Make una tell una dotas and neighbours wetin God tok: “Dead body go full evriwhere like manure wey dem skata for farm or korn wey dem gada for groun.”
“But na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt; I go make una stay for tent again, just as e bi wen una dey do Shelta Feast.
Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?
just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”
“But dem ansa, ‘No! Wetin wi get nor go rish wi share, instead make una go buy for unasef.’
Wetin pesin fit use take eschnage for en life?
E die so dat evribody go dey free. Na dis message God go give di world, wen di time don rish.
Una know sey, God free una from di empty life wey una kollect from una grand-grand papa dem and E nor buy una with sometin wey fit spoil like silva or gold,