Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 49:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Dem bilive dia money kon dey boast with all di tins wey dem get.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 49:6
17 Iomraidhean Croise  

E kon dey boast give dem sey e get money well-well; many sons; how di king don promote am and how e dey important to di king pass any oda offisa.


Dem nor dey fear bad news; dem always dey trust God sey E go kare and guide dem.


Dem get mind and dem nor dey fear as dem dey fight and distroy dia enemies.


“Si wetin happen to dis man wey nor trust God and tink sey e strong. E trust en money kon dey happy for di wiked tins wey e dey do.”


Evriday, dem dey kause wahala for mi. All wetin dem sabi, na to dey plan bad tins against mi.


So my God, make Yu distroy dem bikos of di bad tins wey dem dey do. Make Yu nor let dem eskape!


So, make yu nor trust wetin yu get thru opreshon! Nor put hope for wetin yu tif! If yor money many, make yu nor too happy.


Money dey protet rish pipol, but poverty dey distroy poor pipol.


Doz wey trust dia propaty, go fall like wetin harmattan breeze blow; but raitious pipol go prosper well-well, dem go bi like sun wey dey shine.


bikos yor money fit finish wons like sey e get feada kon fly leave yu like eagle.


God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.


Efraim pipol sey, “Wi get money well-well and nobody go fit akuse us sey wi use wayo take get awa money.”


Di disciple sopraiz for wetin Jesus tok. But Jesus tell dem again, “My shidren, e go hard well-well to enter God Kingdom o-o!


Den I go tell mysef, “Yu get plenty food wey go last yu for many years, so make yu go sleep, chop and drink, dey enjoy yorsef!” ’


Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan