3 Bikos wetin I dey tok, dey good and wetin I dey tish, dey give pipol wisdom.
All my words na true and na true I go tok.
But if yu nor get, make yu kwayet listin to mi and I go tish yu wisdom.”
Make wetin I dey tink, make belle sweet am and I go rijoice bikos of my God.
Di tishing for yor word dey give lite, so even pipol wey nor go skool dey undastand am.
My Oga God wey bi my Rock and Savior, make di word from my mout and di tins wey I dey tink, dey good for yor eye and sweet Yu well-well.
Doz wey dey fear God dey advise pipol well and dem dey tok wetin dey rite.
Make una know sey, God dey keep doz wey dey fear am for ensef and E go ansa wen wi koll am.
Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.
Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok,
As good pesin dey bring good tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart too.
Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain; make wetin I dey tok bi like dew for morning. Make my words fall like rain on-top grass and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow.