2 Di mountin dey high and fine well-well; di whole eart dey happy to si am! Mount Zion wey bi di holy mountin, na-im bi di town where di great King dey stay!
Doz wey bin dey opress una, dia sons go kom bow for una. All di pipol wey look down on una before, go kon woship una. Dem go koll una, ‘Oga God Town. Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’
“So make una happy with Jerusalem; all of una wey like dis town, make una happy for am! All of una wey bin dey mourn for am, make una happy with am naw!
God sey, “I go take una back as my shidren kon give una betta land; di land wey fine pass for di whole world. Den una go koll mi, ‘Papa’ and una nor go turn from mi again.
Pipol wey dey pass di town dey look una with shame. Dem dey laf and shake dia heads, bikos Jerusalem don skata. Dem sey, “Nor bi di fine town wey di world bin like well-well bi dis?”
Curse dey di pesin head wey dey play wayo and offa yuzles animal, wen e bi sey e get many betta animals wey e promise sey e go give mi! I bi strong king and all di nashon dey fear mi.”