Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 47:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 God dey waka go en throne and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 47:5
26 Iomraidhean Croise  

En and Israel pipol blow trumpet kon dey shaut as dem dey karry di box with happiness go Jerusalem.


Doz wey dem choose to blow trumpet for di Kovenant Box front na: Shebanaya, Joshafat, Netanel, Amasai, Zekaraya, Benaya and Elieza and all of dem na priests. Dem still choose Obed-Edom and Jehaya make dem dey guide di box too.


So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.


Na Heman and Jedutun dey kontrol how dem dey play di trumpets, cymbals and di oda tins wey dem take dey praiz God. Na Jedutun sons dey guide di gate.


Make wi praiz am with trumpet sound; make wi praiz am with jita and harp!


bikos na en bi di Pesin wey dey di sky from one generashon go rish anoda! Si! Na-im dey make dat loud tonda nois.


Den God raiz-up like sey E just dey wake from sleep; like strong soja wey en eye just klear from drink.


Make una blow ram horn wons new moon or full moon festival start!


trumpets and di sound from ram horn. Make una sing with praiz, before di King wey bi awa God.


Dat time, I promise sey I go take dem komot from Egypt go di land wey I don choose for dem. Di land wey dey okay, good and e fine well-well.


Naw, Oga God swear with en name sey: “I nor go forget all dis evil tins wey una don do.


I go ponish una shidren-shidren and di animals wey una dey sakrifice, I go rub una face for dia shit and dem go karry una komot for my present.


Wahala nor go happen to Jakob shidren; Israel pipol nor go si trobol. Bikos di Oga wey bi dia God dey with dem and na-im bi di king.


Before wi klose awa eye open am, e go don happen. As dem dey blow di last trumpet, all doz wey don die go raiz. All of us go shange, so dat wi nor go die again.


God big angel go shaut dey kommand as Christ dey kom down from heaven; di angel vois go dey loud with God trumpet and doz wey bi Christian before dem die, go first go up.


Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.


Wen una hear di trumpet sound, make di sojas shaut for war and di town wall go fall rish groun, den una go attack am.”


Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan