Naw, my Oga God, make Yu kom save us! Make Yu gada us back from evriwhere wey wi skata go, so dat wi go tank yor holy name kon happy as wi dey praiz Yu.
Una go komot from Babilon with joy and dem go lead una komot from di town with peace. Di mountins and hills go dey sing and di trees go dey shaut with happiness.
God even sey, “Make una sing and happy for Israel pipol; make una happy for di nashon wey great well-well. Make dem hear una praiz for evriwhere kon sey, ‘God, make Yu save yor pipol, diliver Israel pipol wey remain.’
“Even di strongest mountin nor go fit stand fight Zerubabel, bikos di mountin go turn ordinary groun for en front! And wen Zerubabel don put di final stone for where e suppose dey for di temple, di pipol go shaut, ‘Make God bless am! Make God bless di temple well-well!’ ”
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!” All di pipol kon shaut, “Di king go stay forever!”