12 Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts. Doz wey get money go kom make una help dem.
Make rish pipol for di world kom woship am. Evribody must bow to am, plus doz wey don die and doz wey nor fit save dia own life.
as Yu kom out from yor temple for Jerusalem, bikos kings dey kom give Yu respet for der.
Tarshish kings for west and di oda kings go kon pay respet to am. Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.
Yu bi like dove wey hide inside rock, so make yu allow mi si yor fine face kon hear yor sweet vois.
My love, kom dis nite make wi go sleep on-top di flowers for di field.
Kings go bi like una papa and kweens go bi like una mama. Pipol go bow dey honor una with respet. Den una go know sey na mi bi God, bikos I nor go disgrace anybody wey dey wait make I help am.”
Nashons go kom enter una lite and kings go enter una brite lite.
Dem enter di house, si di pikin with en mama kon knee down woship am. Den dem open dia bag kon gi-am some gifts wey bi, gold, frankincense and myrrh.