10 All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart. Make una forget una pipol and family wey dey far-far.
Naw, God kon tell Abram sey, “Komot from yor kountry; leave yor relashon and yor papa house kon go di land wey I go show yu.
Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.
Dem travel with ship from Ofir kon karry gold wey heavy rish 420 pounds go give King Solomon.
But Hobab ansa, “I nor go follow una, instead I go-go my own land go meet my pipol.”
“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.
And anybody wey leave en house, brodas, sistas, papa or mama and land bikos of mi, go get am back hundred times and e go get life wey nor dey end.
“If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.
So naw, wi nor dey look anybody like ordinary human being. Even doh wi bin know Christ like dat before, wi nor know am like dat again.
Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una
burn di klot wey e wear wen dem katch am, den kon stay una house. E go take one mont take mourn for en papa and mama wey die. Den una fit marry am as una wife.
Dem tell dia papa and mama sey, ‘Wi neva si am’ and e nor do like sey e know us or en own shidren, bikos dem keep yor word kon guide yor kovenant.