“E neva too tey wey yu kom here, so wetin go make mi allow yu sofa with mi? I nor even know where I dey go. So, make yu go back go meet yor pipol and make God dey kind and trit una well.”
Den di king tell Zadok, “Make una karry di Kovenant Box go di town back. If God dey happy with mi, E go still let mi kom back kom si am for where e dey.
As all dis tins dey happen, di tent wey Moses build for desert and di altar where dem for dey burnt sakrifice put, still dey where dem for dey woship for Gibeon.
I start to kry wen I remember as tins bi before! Den I dey waka with doz wey dey woship God; dey lead many pipol go God house and wi dey happy as wi dey sing and dey tank am as wi dey celebrate!