8 But evriday, God dey pour en love wey nor dey fail for my life and evry nite, I dey sing en song, dey pray to God wey give mi life.
Deat dey round mi; e bi like sey dem go soon distroy mi.
But dem nor dey kry to God wey kreate dem; wey dey give dem hope for darkness.
River for don kover us; wota for don karry us go.
E bi like di dew for Hermon wey dey flow from Zion hill. True-true, na der God for sey en blessings go always dey forever and ever.
Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem! Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!
So I go bless God wey dey guide mi; even for nite, my heart dey happy to praiz am.
Na God bi my lite and my salvashon, so na who I go kon dey fear? Na en dey guide and protet mi from danger, so wetin go make mi dey shake?
Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol. God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.
Na Yu bi my King and God. Na Yu make Israel pipol win.
and E go send help kom from heaven kon save mi, den disgrace doz wey won kill mi. My God go send en goodness and love wey nor dey fail kom.
and for nite, I nor dey fit sleep, bikos I dey tink about how Yu
wen betta song with joy full my nite. But naw, I dey look my life kon dey tink and si how e dey difren.
Yu don porshu my friends kon fool mi for dia front and naw, I dey for trap wey I nor go fit run komot.
But una go sing just as una dey do wen una dey do festival for evening; una go happy like pesin wey dey blow trumpet go woship for di Oga God mountin; di God wey dey protet Israel.
I go kommand my blessing for una for di sixt year, so dat di land go produce food wey una go chop for three years.
Den I sey, ‘Oga God, Yu don drive mi komot from yor present kpata-kpata and I nor go ever si yor holy temple again!’
But di offisa sey, “Oga God, I nor big rish who yu go enter en house, instead just tok and my savant go well.
Wen mid-nite rish, Paul and Silas kon dey pray and sing song give God and all di pipol wey dey di prison dey listin to dem.
God go kommand blessing for una aria and for evritin wey una dey do; yes, E go bless una for di land wey E dey give una.
bikos una don die and una life dey save with Christ for inside God.