7 I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef! Yor wave and breeze dey make my heart shake.
Yu must get pipol wey go tok against mi; yor vexnashon dey big evriday by day and na new attack Yu always dey plan for mi.
Yor vexnashon dey press mi and yor waves don kover mi.
I hear as wahala dey happen for evriwhere! Di whole land don skata finish. Yes! Na wons dem distroy awa tent kon tear awa curtains to pieces.
One diziz go follow anoda and na so-so bad-bad news una go dey hear. Una go beg di profets make dem tell una wetin dem si. Di priest nor go get anytin to tish di pipol and una eldas nor go fit give betta advise.
Na Yu God trow mi inside dis deep sea. Yu trow mi inside di river and di wota and waves kon kover mi.
So for dat time, wi take di two king for Amor land for (Trans-Jordan) go rish River Arnon and Mount Hermon