Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 41:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 So make una praiz di Oga wey bi Israel God, bikos E dey alive forever and ever. Amen!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 41:13
19 Iomraidhean Croise  

Benaya ansa, “I go do as yu tok and make God wey bi yor God asept am as king!


Make di Oga wey bi Israel God get all di praiz from naw and forever.” Den all di pipol ansa, “Amen! Wi go praiz di Oga awa God!”


For der wey all di pipol gada put, David praiz God kon sey, “God wey awa papa Jakob serve, wi praiz yor name forever!


Make wi praiz di Oga wey bi Israel God wey dey alive forever and ever! Make all di pipol sey, “Amen!”


God dey support pipol wey nor dey karry body up, but E dey kill wiked pipol trowey.


Make evritin wey dey alive, sing praiz God. Make evribody praiz God!


But with all dis tins wey dey happen, na God wi go praiz forever and ever! Amen and Amen!


“Amen! Make God make yor profesy, happen! Make E bring all di betta-betta tins wey dem take from en temple and all di pipol wey dem karry go Babilon as slave kom back to dis place.


As dis wota enter my belle, I nor go fit born again.” Di woman go gri sey make God do am like dat.


Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’


If some strenjas dey for where una for dey woship God for spirit and dem nor undastand una, how dem go take know wen to sey, “Amen”?


I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.


And dem go sey: “Awa Oga God wey dey mighty, wi dey tank yu. Di one wey dey since and wey go always dey, bikos naw, yu don show yor pawa kon start to rule.


Di Pesin wey dey tok dis tins, know sey dis tins na true. Jesus Christ sey, “True-true, I go soon kom!” Amen! Oga God Jesus, make yu kom!


Each for di for creatures get six feada and eye full di feadas. Dem nor dey ever rest for nite or day and dem dey always sey: Holy! Holy! Holy! Na-im bi di God wey dey mighty. Di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go soon kom.


Dem kon dey sey: “Make praiz, glory, wisdom, tanks, honor, authority and pawa bi awa God own forever and ever. Amen!”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan