12 Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent; Yu don let mi enter yor present forever.
E dey protet good pipol; E dey let dem live like kings and pipol dey respet dem forever.
Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.
Bikos I dey raitious, I go si Yu. Wen I don leave dis world kom meet Yu, I go si Yu face-to-face and belle go sweet mi.
As I dey loyal and honest rish, Yu dey protet mi, bikos na Yu bi my hope.
My Oga God, I dey kry to Yu for help and Yu don make mi well.
Pipol wey dey do wetin dey rite, God eye nor dey komot from dia body and en ear dey open to hear wen dem kry for help.
God go take wiked pipol pawa, but E go protet doz wey dey fear am.
I hold Yu tait, bikos na yor strong rite hand dey save mi.
But I shaut kon kry sey, “I dey fall” so Oga God wey en love nor dey fail, kom support mi.
Papa, I wont make di pipol wey yu give mi stay with mi for where I dey, so dat dem go si di glory wey yu give mi, bikos yu love mi before yu kreate di world.