16 But pipol wey dey find Yu, make joy and gladness full dia heart. Make doz wey love yor salvashon always dey shaut sey, “God dey great!”
Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God, make wi happy.
Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont
I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi; so dat evritin go bi just as Yu promise mi.
I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
Make doz wey dem dey opress, si food kon chop beleful. Evribody wey dey fine God, go praiz am and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.
Dem go dey shaut, “Yes o-o! Yes o-o! Wi don get am at last!”
But make Yu give joy and happiness to pipol wey dey help mi. Make dem always dey sey, “God dey great and E wont make en savant dey save!”
But pipol wey dey fear God go dey happy; dem dey happy for God present and dia joy nor dey end.
“Man pikin, dis na wetin Tyre pipol dey tok about Jerusalem. Dem sey, ‘E get pawa before bikos of en money, but naw wey di town don skata, wi go get plenty money kon strong pass am!’
Wen evribody wey dey stay Efesus, both Jew and Greek, hear di story, fear katch dem and Jesus Christ name kon dey reign.