6 Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.
So, anytin wey go make yu sin, make yu remove dem from yor mind, so dat yor body go dey strong, bikos yong life na for enjoyment. But remember sey yu nor go yong forever o-o.
God dey give wisdom, knowledge and joy to pipol wey dey do wetin E wont. But if pesin wey dey sin get money and propaty well-well, God go take dem from am kon gi-am to pesin wey dey do wetin E wont. All dis tins dey yuzles too and dem bi like wen pesin dey porshu breeze.
Silva, golds and oda good tins wey I karry from oda kings and nashons, I still save dem for mysef. I hire good singas, both men and wimen and I get many fine-fine girl-friends. Yes! I get evritin wey suppose make man happy!
Why una dey spend una money for wetin nor go beleful una? Why una dey spend una money wen una know sey hongry go still kill una? Make una listin and do wetin I tok, den una go enjoy di best food.
E nor go make any difrence even if yu get all di tins for dis world or sey yu like di world well-well, bikos as wi know, di world go soon vanish komot.