19 I get many wiked enemies and dem hate mi without any rizin.
E save mi from my enemies wey get pawa well-well; from doz wey hate and too strong for mi.
Si as my enemies many pass mi and as dem hate mi rish!
My God, make Yu si as my enemies many rish! Many of dem dey kom attack mi.
So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!
Make Yu nor let my enemies happy sey dem win mi. Make Yu nor let pipol wey hate mi, even doh I nor do anytin, happy bikos I dey sofa.
Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!
Evribody go hate una bikos of mi. But anybody wey fit bear rish di end, God go save am.