13 But I bi like who nor dey hear wetin dem dey tok. I kwayet dey look dem like sey I nor sabi tok.
Even doh wiked pipol set dia trap for mi, I nor go turn from yor kommandment.
But even as I dey kwayet and nor tok wetin good or bad, my sorrow and pain still dey worse more-more.
I kwayet for yor present; I nor go tok anytin, bikos of wetin Yu don do.
Dem trit and ponish am anyhow, but e put body down kon bear-am like lamb wey dem won go kill and e nor tok anytin.
Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha.